jueves, 10 de enero de 2013

Laudrup dey do yanga for Michu market - SuperSport (blog)


Swansea manaja dey blow in trumpet dey waka wit yanga as per say in hamma wen in sign Michu, come follow yarn say na juss veri few klub dem go fit enta market buy the Spain strika wey dem sign for small kulele.

Michu wey nack anoda gol for the 2-0 wey Swansea do Chelsea for the capital one semi-final for Stamford Bridge na the " bargain of the season" becos na onli two million pound ($3.20 million) dem take buy am dis seasin

" No be me dey hang price for playa head" Laudrup tell repotas dem afta Michu cari in left foot do Chelsea strong tin score afta Branislav Ivanovic bin make mistake.

" We sabi how tins be, moneey dey hard nowadays, so na veri few klubs dem fit komot moni buy am

" Some dey here ( na Ingiland b dat), For Spain maybe na two, Italo? Nada, lailai, dat side too tight, dem sef dey try sell playa. Bayern Munich for Germany fit try, infak klubs wey fit buy no plenti"

Wit the way football dey go, all the kulele wey dey, the transfa fees wey pipu dey pay, the way dem take buy Michu don show say pesin fit find diamond inside Europe football sand wey don dirty finish.

The way in tap ball for Wednesday don make pipu dey yarn about Fernando Torres ( the two of dem na Spain playa), some fans sef come dey shout dey boo Torres for the match wey b in numa 100 wey in don play for Chelsea.

Torres, wey Chelsea sign from Liverpool for Januari 2011 for 50 million pound don score onli 26 gol for dem, and if u pass maths for skool, dat one na like 2 million for evri gol be dat, for all the kulele wey Chelsea drop ? E be like like once chance Chelsea enta., becos Michu own go be like 125,000 pounds for evri gol wey in don score for Swansea dem.

The ogbonge part of the gist be say, Swansea sef sign Michu make e play attacking midfield, even as in show for La Liga say e sabi score, now pipu don dey ask weda Swansea go fit kip am for deir side.

"Michu likde dis side" Laudrup add join. " The guyman dey hapi, no shaking, i no fear lai lai, becos i sure say in go still dey here for anoda five to six months like dat"

" I no know how much in go cost oh, Na chairman una go ask dat one. Na korrect market for us dis seasin so, we sabi nah! No lele

No hay comentarios:

Publicar un comentario